G' W🌎RLD: Hear what one of our Nigeria sports journalist say concerning the dead of one of our Nigeria footballer, Samuel Okwaraji

One sports Journalist wey im name na Cyprian Ajah don come out on Saturday, 12 August 2023. dey para for NFF say wetin dem do their former player wey kpai for pitch wey im name na Samuel Sochukwuma Okwaraji  no good.



Oga Cyprian say today which was the 12 of August make am 34 years wey Okwaraji d!e and the way NFF take handle the matter no sweet am.


Oga Cyprian say if na other countries wey sabi something say dem go organize memorial service or football match for Okwaraji but NFF do like say e no concern dem.


Samuel Okwaraji bin d!e for pitch in 1989 for National Stadium Surulere, Lagos when e dey play Worldcup qualifying match against Angola.


My people abeg how una see wetin oga Cyprian Tok?

Comments

Popular posts from this blog

GIST: Popular TikTok star, The Buba Girl’s leaked video breaks internet

G' W🌎RLD: Fuel price set for another increase